1. You see identical twins, you
still dey ask 'na twins be dis'?
No bros, na picmix...lol
2. Nepa brings light and
everyone in the neighborhood
shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
3. You see person dey vomit, you
still dey ask am 'you no well'? Em
well, e just dey practice how to
vomit make he for do freedom.
4. You just wake up from sleep;
person come ask you "you don
wake?" No oh, I come buy bread
wey I go chop for dream.
5. You see woman wey born new
pikin; u come
ask her "madam u don
born? " No ohhhh, she buy am
for OLX...
6. You greet person "good
morning ma" ! She ask, my pikin
you don
wake????
No ohhhh, I dey sleep walk... .
7. My guy ask me "O boy where u
dey?" I tell am say i dey bank, nd
him ask me "Wat is happening
there?"
No Nah new yam festival..
*LMAO*
8. My neighbour sees me
opening the gates to drive out
and asks me, U dey comot? Not
at all... I
be the new gateman...
9. I dey watch film… my guy enter
come ask me "Guy na film u dey
watch? No naa... I dey discuss
with Osuofia...
10.U see me dey chop indomie
come dey ask me, O boy, na
indomie u dey chop so? No
ohhhh. Na fried rubber band
mixed with thread.
No comments:
Post a Comment