Most Popular

Thursday, 8 September 2016

Comedy: Nigeria performance 2016 Olympics

Small time Ijaw men go jump
enter water like fish, See
swimming for Olympics, ZERO
medal for Nigeria.
Igbo man go dey tumble for
Atilogwu, see gymnastics for
Olympics, no entry.
Hausa man go enter boat dey
shout Argungu Fishing Festival,
See Rowing at the Olympics, ZERO
medal for Nigeria.
Fulani herdsmen fit shoot arrow
from 1km kill anyone wey wan
steal dem cow, Olympics reach,
make dem go do Archery dem no
gree show face.
Yoruba man will remove clothes,
wrist watch and pant to fight at
Ojuelegba. See boxing at the
Olympics, zero medal.
The one wey vex me pass na
Warri people.
Warri man go say Warri no dey
carry last......wetin Blessing
Okagbare, our own Warri girl
carry for 100m Olympic finals?
No be last..?
I taya 4 Naija sef. Una well done
Is dat tru?
Thank God for d likes of
Adekunle *Gold* and Joke
*Silver* for topping d medals
table in Nideria though.

No comments:

Post a Comment